FACTS WITH PENDUSKY (MID-WEEK EDITION)



WELCOME TO THE FIRST EDITION OF MID-WEEK FACTS WITH PENDUSKY

SABI BOYS AND GURLS, ABEG MAKE WE CHECK OUT SOME PIDGIN PROVERBS

 1. The difference between Kpekere and plantain chips na packaging

 2. Feel at home, feel at home, na so visitor take dey spoil television.

 3. Person wey belle full today, go hungry tomorrow.

 4. Lean on me, lean on me, no mean say make you suffocate me.

 5. Bring Suya, bring Suya, na cow body dey suffer am.

 6. Life be like standing fan. E blow you small, e blow your neighbour small.

 7. Jollof Rice wey dey bottom pot today, go dey for top of cooler tomorrow.

 8. Do you know who I am, do you know who I am, na so traffic dey take start.

 9. Akara and moin moin get the same parents. Na wetin dem pass through make them different.

 10. No be who first call Police dey win the case.

 11. Monkey smart, monkey smart, na because tree near tree.

 12. I dey shame, I dey shame, na so person take dey die in silence.

 13. E no get as e be wey e never be before.

 14. Person wey dey ask question no dey lost.

 15. No food for lazy man no be for pikin wey im mama dey sell food.

 16. This one good, that one good, na im make mad man load plenty.

 17. When money dey, friend go dey. When money go, friend go go.

 18. Mosquito wey no dey hear word na im dey follow dead body enter grave.

 19. Use rope tie goat, tie goat rope, na the same thing.

 20. Chop this man money, chop that man money, na so ashawo dey start.

Witch proverb you enjoy pass, abeg drop your comment 4d comments box wey dey down there.

We go jam for this same time next week.





God Bless una.




 Ubong Effiong also known as Pendusky is a Customer Experience Management Personnel with Sterling Bank Plc.


Comments