FACTS WITH PENDUSKY (MID-WEEK EDITION)



Sabi Boiz and Gurls, make we continue with our Pidgin proverbs wey we start last week.

        I.            Use rope tie goat, tie goat rope, na the same thing.
      II.            The difference between Kpekere and plantain chips na packaging.
    III.            Na footballer wey ball dey im leg camera dey follow
  IV.            You see "thank you", you dey find "very much".
    V.            Na village wey native doctor know e dey disappear.
  VI.            No matter the size of elephant, e no fit cause earthquake.
VII.            When breeze blow, fowl yansh go open.
VIII.            Pikin wey hide cane wey dey for house forget say bush near.
   IX.            Cow wey rush go abroad go come back as corn beef.
     X.            Na the same hot water wey dey make egg hard dey make Potato soft.


Abeg which one blow your mind pass? Biko use comment box. #FactsWithPendusky

Takeaway - Make Una watch for the special Ramadan Version of #FactsWithPendusky ahead ooh...

My Name na Ubong Effiong (Pendusky).



 Ubong Effiong also known as Pendusky is a Customer Experience Management Personnel with Sterling Bank Plc.

Comments